🦷 Heavenly Barcode? Church for Kenya Dey Remove Teeth So God Fit Recognize Members for Heaven!

 🦷 Heavenly Barcode? Church for Kenya Dey Remove Teeth So God Fit Recognize Members for Heaven!

By Prince Agbedeyi Odimientimi Desmond
Edited by Seigha Dora Ayedi
For Global Egberi Media International

Wetin Africa no go hear for name of religion?

For Kenya, one church wey dem dey call Legio Maria Church don carry matter go another level. According to dem, if you no comot six of your lower teeth, e go hard God to recognize you when you reach heaven. Dem say na only their members go make am enter heaven straight — others? E go be one-way ticket to hell fire with no return.

Na true talk: six teeth out = direct entry to paradise.

🧐 How E Take Start?

😅 Wahala for Who Get Full Set of Teeth

Dem believe say God no too dey remember face, but once He see gap for down, He go shout:
“Yes! Na my Legio pikin be this!”
🙆🏾 Religion Don Show Us Shege
We no say religion bad. But when e reach the point where dem dey use plier collect person teeth in the name of God, we need to ask:
Na salvation or oppression? Na worship or warfare?
✊🏾 Time to Shine Eye
📢 Final Word
So, ask yourself:
You dey serve God, or you dey serve man wey claim say he know God pass everybody?

This church no be today e start. Dem break away from Catholic Church around 1960s, follow one prophet wey say Jesus don come back again as African man. Since then, na so dem begin mix Bible with some strong African traditional styles.

Now dem don carry am reach mouth surgery level. As you dey join the church, dem go remove six of your lower teeth sharp-sharp — as spiritual ID card. No be say e cure malaria o, or make you holy pass others. Na just so that Angel Gabriel go sabi you for judgment day.

If you still get all your 32 teeth, just know say you go need visa before you fit enter heaven — according to dem. Heaven don turn to secret club. Na only people wey don brush with tooth removal dey qualify.

From pastors wey dey sell "anointed koboko" for deliverance, to prophets wey dey marry angel for dream, to churches wey dey preach say makeup na straight road to hell — Africa don suffer for hand of religious wahala.

Africans need to shine eye. Make we use sense follow Bible or Quran. Make we stop to fear pastors more than we fear God. Faith no suppose be bondage.

Na who do good, love others, and live upright dey go heaven — no be who comot teeth join church.

Legio Maria Church believe say dem be the only one wey go see God. But if heaven really dey do teeth inspection, many of us go miss out.


📞 For Advertising and Booking:

Contact: +2348134902214 or +39 348 610 6794

💰 For Payment and Support:

Account Name: Agbedeyi Odimientimi Desmond
Account Number: 3017861172
Bank: First Bank

Global Egberi Media International — We dey bring truth with boldness and style.

Comments